Indian wrestler Vinesh Phogat chop disqualification from di Paris 2024 Olympics wrestling competition sake of say she dey overweight.
Vinesh Phogat suppose compete for di women 50kg category final fight wia she stand a chance to win gold bifor dem disqualify her.
For Paris 2024, evri weight category dey organised over two competition days. Di medical control and weigh-in for each category dey happun for di morning of di first competition day.
On di second competition day, wrestlers wey don qualify for di finals and repechage go check dia weight again.
For Olympic sports, repechage na second chance for athletes wey lose for di early rounds to compete again and potentially advance to di next round or final.
In wrestling event, repechage na consolation bracket for wrestlers wey lose to a finalist, e dey allow dem to compete for a bronze medal.
Na for dis second checking of weight of pipo wey qualify na im cause kasala. And di Indian contigent announce say dem don disqualify dia wrestler.
“Na with regret wey di Indian contingent dey share news of di disqualification of Vinesh Phogat from di women wrestling 50kg class,” di Indian Olympic Association (IOA) tok for statement.
“Despite di best efforts by di team through out di night, she weigh few grams over 50kg dis morning.
“Di contingent no go make further comments dis time. Di Indian team request say make una respect Vinesh privacy. We go like to focus on di competitions wey we get for our hand.”
Skip Twitter post, 1
Allow Twitter content?
Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of Twitter post, 1
Nigerian authorities react afta Favour Ofili para say dem comot her name from 100m Olympic race
How Nigeria medal hopefuls miss out on Day 11 of di Olympics
Athletes wey dey breastfeed get Olympic creche for di first time in history
Wetin di wrestling rule tok
According to wrestling rules, if any wrestler fail di weigh-in on either day of di competition (preliminaries, and repechage and final rounds), dem don comot from di event.
Vinesh, wey bin dey unseeded, bin qualify for di final afta she win three bouts on Wednesday.
Di three-time Commonwealth Games champion bin defeat top seed and defending Olympic champion Yui Susaki of Japan for di opening round.
For di quarter-finals, she also beat former European champion Oksana Livach of Ukraine.
She con beat di reigning Pan American Games champion Yusneylis Guzman of Cuba for di semi finals.
Vinesh Phogat suppose to fight with USA Sarah Hildebrandt, wey be sixth seed for di final wia she be potential Gold medallist or worse case Silver medallist if she lose di fight.
Vinesh Phogat bin dey eligible for competition on di opening day but weigh just few grams over 50kg on Thursday morning.
According to Hindi Times, Vinesh dey usually compete for di 53kg category but she bring her weight down to 50kg sake of di Paris Olympics.
On Day 2 of her weigh-in, dem find out say Vinesh dey weigh over di approved limit, even though na with a small margin of about 100 grams.
Di Indian Olympic Association don file appeal on di mata already.
Tori be say Vinesh try to do evritin she fit to come under di desired weight. Hindi Times report say she skip meals, she no gree chop, she begin run. She no sleep through out di night with di hope to fall under di weight category.
Di Indian officials also beg di Olympic committee for more time but all dia efforts no work out.
Earlier, Vinesh bin don ready to make history as di first Indian woman to reach di final of a wrestling event for di Olympic Games.
Di Indian coach tok say Vinesh dey overweight by just 100gm on Wednesday morning. Though di margin dey small, di rules no allow any exception.
How Indians react to di disqualification
Indians dey para for social media about di disqualification of dia ogbonge wrestler.
Skip Twitter post, 2
Allow Twitter content?
Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of Twitter post, 2
Skip Twitter post, 3
Allow Twitter content?
Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of Twitter post, 3